top of page

    Menstrual cup na wetin?

- Menstrual cup na small cup wey dem make with soft medical rubber wey you fit put inside to collect period flow. E dey safe pass pad and you fit use am again and again for up to 15 years.

   How I go use dis cup?

- First time, you go fold am small-small, den put am inside like tampon. E go open by imself and collect all de flow. You fit leave am for 12 hours before you comot am.

   E dey pain to use menstrual cup?

- No, e no suppose ain if you put am well. But if e pain, you fit try another size or practise to put am well. 

   How I go clean menstrual cup?

- After you commot am, wash am with clean water and soap. When period finish, boil am for 5 minutes to kill any germ and store in the bag.

  Wetin be the benefit of menstrual cup?

- E go save you money wey-wey because you fit use am for many years. E dey Eco-friendly, and e no dey smell like pad.

   Wetin I go do if I no fit remove am?

- Relax your body and try again. If e still hard, squat small or use your clean finger to press the base to release vacuum.

   If I get heavy flow, menstrual cup go work for me?

- Yes, E go work. You fit empty am more often if your flow dey heavy.

   Where I fit buy menstrual cup for Nigeria?

- You fit contact cups of change or check local farmacy wey dey sell menstrual hygiene product. 

   Na only rich people fit use menstrual cup?

- No, e dey for everybody. Cups of Change dey distribute am free for women wey need am. 

bottom of page